Obi Cubana
Obi Cubana burial: 'How I make my first N1m and why I bury my mama like dat for Oba' - Obinna Iyiegbu Obinna Iyiegbu na di owner of di Cubana chain of restaurants and entertainment business for Nigeria Obinna Iyiegbu, wey pipo sabi as Obi Cubana, don reveal inside exclusive interview with di BBC Pidgin, im life tori and journey. Di 46-year old business man from Anambra state for eastern Nigeria wey dey into entertainment and hospitality business, from im hometown of Oba, Idemili South, Obi Cubana sidon to tok many tins, including about di early days of im business life. Di business mogul wey di burial of im mama for im hometown Oba over di weekend of 16, 17, 18 July, 2021, become di biggest tori for social media, tok about di role of im parents, im education and how im make im first N1m ($2,400). Fotos - Celebs wey don show for Obi Cubana mama burial Wetin we know about Obi Cubana source of money Di Burial Over di weekend of 16, 17, 18 July, 2021, di burial of Obi Cu...